The Day SARS Became the Victim ๐Ÿ˜œ

nigeria police brutality

OK so una don ready for this gist?...
แบธ get one new house wey dem just build finish like 3months ago, so na young young guys dey inside d house about 4 of them, flashy cars bla bla bla and bla...so yesterday d devil (SARS) go pass boundaries at about 2:45pm
Sienna park for front of the house bang gate...bang gate..nobody answer den, na so two of them use plyer cut the electric fence jump inside d compound... Be like say those guys dey play loud music for inside so dem no hear d banging, sars Sha fly fence inside dey Waka about
Na him one of them come out dem catch That one start to dey rain ham slap๐Ÿ˜‚๐Ÿ˜‚...this is where d action begins, the guy just manage cut commot run enter, coming, coming out... 1 huge elderly man (their father, 4 hefty guys, all brothers, 1 fine babe) all match outside
Papa ask dem wetin dem dey fine for him compound, dey say dey come arrest thus boys say dem be yahoo yahoo (fraudulent) according to how d sars guy call ham cos we dey look from d upstairs of d next compound.
At dis junction all d sars guys Don dey inside d compound..
Dis elderly man Waka go gate, go lock d gate, now properly introduced everyone in d compound.
1. Major General Akinpelu Olopade (dad)

2. Captain Olakunle Olopade (son)

3. Lieutenant Olรบwafemi Olopade (son

4. Flying officer Olayinka Olopade (son)

5. DSP Funmilayo Olopade
The whole family entirely na military and Forces ๐Ÿ˜‚๐Ÿ˜‚๐Ÿ˜‚ na him sars start to dey beg, dey were all disarmed, handcuffed to the gate, chop beating wey dem never chop before, sars dey cry....
Now this kind raiding na information, who gave Y'all dis false info dem say na...
Dem say na landlord of house 45 or so... Na him dem go drag that one come outside, na d man dey always drop pass for those sars guys, ahhh old man chop koboko๐Ÿ˜‚๐Ÿ˜‚๐Ÿ˜‚
2 hrs after all this we start to dey hear wow wow wow wow wow siren sound.. With old Landrover
Gen gbรฉ Military Police, military police come start their own also, แปju sรกrs tรญ wu รณรฒ, handcuff all of them, throw inside motor, including d landlord, landlord wife dey beg dey roll for floor, nobody answer ham, wแปn gbรฉ gbogbo wแปn lแป mehn,
Those sars guys Don enter ham.
OK guys one of them is in my DM... I think I have a new frnd.....๐Ÿ˜‚๐Ÿ˜‚๐Ÿ˜‚
Engine Overheating Problem and Solution opr.news/s7420368519121…#OperaNewsHub
make una read from my Opera News Hub abeg
Y'all RT MY PINNED TWEET PLS

No comments

Thanks for stopping by.

Covid 19: How does your immune system work?

Written by Phil Cain Image: REUTERS/P. Ravikumar Until a vaccine is available, our immune systems will need to adapt unaided to COVID-19. T...

Powered by Blogger.